NAIJA NOMAD

naija nomad
Home­FAQ­Search­Memberlist­Usergroups­Register­Log in
Post new topic   Reply to topicShare | 
 
 Breaking News!!!

View previous topic View next topic Go down 
Goto page : 1, 2  Next
AuthorMessage
Wetin?

Posts: 31
Join date: 2008-04-03
Location: Naija

PostSubject: Breaking News!!!   Thu Apr 03, 2008 12:24 pm

Adesuwa road cyber cafe Monte Carlo has been bursted by the EFCC and police officers today. Everyone found in the premises were arrested and taken away in toyota haice buses.

Na message wey I dey receive be that so, Eke don burst yahoo boys for Benin. Na true??
Back to top Go down
View user profile
NEVES IRTH
Admin

Posts: 83
Join date: 2008-04-03
Location: G.R.A, B SIDE, NAIJA

PostSubject: Re: Breaking News!!!   Thu Apr 03, 2008 1:54 pm

Wetin? wrote:
Adesuwa road cyber cafe Monte Carlo has been bursted by the EFCC and police officers today. Everyone found in the premises were arrested and taken away in toyota haice buses.

Na message wey I dey receive be that so, Eke don burst yahoo boys for Benin. Na true??

affraid men my guy, na nepa sieze light again o. i never hear the gist say eke bust monte carlo. if i enter streets later i go enquire.

Last edited by IRTH on Thu Apr 03, 2008 3:00 pm; edited 1 time in total
Back to top Go down
View user profile http://naijanomad.darkbb.com
NEVES IRTH
Admin

Posts: 83
Join date: 2008-04-03
Location: G.R.A, B SIDE, NAIJA

PostSubject: Re: Breaking News!!!   Thu Apr 03, 2008 2:37 pm

make efcc take am easy now!!...lol

_________________
Back to top Go down
View user profile http://naijanomad.darkbb.com
NEVES IRTH
Admin

Posts: 83
Join date: 2008-04-03
Location: G.R.A, B SIDE, NAIJA

PostSubject: Re: Breaking News!!!   Thu Apr 03, 2008 7:14 pm

Wetin? wrote:
Adesuwa road cyber cafe Monte Carlo has been bursted by the EFCC and police officers today. Everyone found in the premises were arrested and taken away in toyota haice buses.

Na message wey I dey receive be that so, Eke don burst yahoo boys for Benin. Na true??

men i just confirm tht gist o, they say efcc bust enough men for monte carlo. men dey enter roof self, no be small thing o. No

_________________
Back to top Go down
View user profile http://naijanomad.darkbb.com
NEVES IRTH
Admin

Posts: 83
Join date: 2008-04-03
Location: G.R.A, B SIDE, NAIJA

PostSubject: Re: Breaking News!!!   Thu Apr 03, 2008 7:34 pm

i just dey enter crib now. no be small thing happen for b side today o, they say efcc with coatie bust enough men for monte carlo, men dey even enter inside ceiling make they for no catch them..

men i need call my guys wey dey do yahoo to see if they bust any of them

fyi, me i no dey do yahoo o, na website i dey run.

the people i feel for pass na the ones wey never collect money for the yahoo wey them dey do. e get one of my guys wey don dey do yahoo since 1999 and na only $700 he don collect till date, and he dey pay for system monthly 30k naira. how tht kind person wan bail himself come out?

_________________
Back to top Go down
View user profile http://naijanomad.darkbb.com
NEVES IRTH
Admin

Posts: 83
Join date: 2008-04-03
Location: G.R.A, B SIDE, NAIJA

PostSubject: Re: Breaking News!!!   Thu Apr 03, 2008 7:39 pm

efcc make una chill now!!! wetin u want make men do? people don graduate from university like 5 years back and they no get job. how u want make they take survive? abi you want make they go dey robb? abeg, why una no dey arrest all the big men, all the politicians wey dey share ghana must go anyhow?

_________________
Back to top Go down
View user profile http://naijanomad.darkbb.com
NEVES IRTH
Admin

Posts: 83
Join date: 2008-04-03
Location: G.R.A, B SIDE, NAIJA

PostSubject: Re: Breaking News!!!   Thu Apr 03, 2008 8:08 pm

e go be l8tr, i don commot. holla me if any details dey..

_________________
Back to top Go down
View user profile http://naijanomad.darkbb.com
Wetin?

Posts: 31
Join date: 2008-04-03
Location: Naija

PostSubject: Re: Breaking News!!!   Fri Apr 04, 2008 7:26 am

O be small tin oo, It was confirmed that EFCC raided Benin and pack boys comot. I even hear say some of the boys wey be try run as dem dey burst the cafe were shot on their legs but why na? Why EFCC go shoot dem? Dem be armed robbers? If you sidon look this tin well, e nor fair oo! 9ja don jaga jaga and work nor dey for dis boys so wetin man go do? Sidon look?

Na govt na coz all this tins, If tins be as e be the time of our papa era? these boys for nor know wetin dem dey call 419. Coz then as you graduate, na once u take get work, so I was told. I even hear say even those with Primary 6 certificate dey get better work back then, so why tins come change?

Today even if you be graduate, it does guarantee that you go get work nor to talk of better one. Firms go say we need those with a second degree (masters) and ten years working experience. So tell me how fresh graduate wan take ever get experience wen everywhere you go they all need ten years working experience?

EFCC make una dey arrest politicians wey spoil dis country for the youths and na dat be wetin lead most of them to yahoo. Solve the problem from the root cause and make 9ja good for the youths again, na only then these boys go leave yahoo coz no matter how una arrest dem reach, they cant leave it coz they dont have any other tin to do to better themselves and family coz as far as they are concerned na work dem dey. Just as Banker or any other worker dey go work in the morning, na so dem dey go too.

Wetin?
Back to top Go down
View user profile
NEVES IRTH
Admin

Posts: 83
Join date: 2008-04-03
Location: G.R.A, B SIDE, NAIJA

PostSubject: Re: Breaking News!!!   Fri Apr 04, 2008 9:52 am

one thing i firmly believe is that naija govt like to dey please other people, they wan make them foreign governments feel say them dey fight crime. instead of make they face the pressing issues at hand, dem go dey bust g men. i be dey chat with my cousin for yankee yesterday, he say whities and black americans for there sabi efcc well, dem dey sing efcc praises anyhow. na that one our govt want,make amerikkka dey pat am for back say he dey fight coruption. No

make we face reality, if not for yahoo, streets for rough now, especially 4 b side. men for go into robbery and all sorts of crimes just to make ends meet, but now as yahoo dey, relative peace done dey the town. even men wey dey do much confra issues those days don cool down dey enter cafe try hustle.....

_________________
Back to top Go down
View user profile http://naijanomad.darkbb.com
NEVES IRTH
Admin

Posts: 83
Join date: 2008-04-03
Location: G.R.A, B SIDE, NAIJA

PostSubject: Re: Breaking News!!!   Fri Apr 04, 2008 9:59 am

abeg, wetin? u dey get any problems viewing this site? e no dey open for my internet explorer again, na mozilla firefox i come dey use, i no know wht the problem is Sad

_________________
Back to top Go down
View user profile http://naijanomad.darkbb.com
Wetin?

Posts: 31
Join date: 2008-04-03
Location: Naija

PostSubject: Re: Breaking News!!!   Fri Apr 04, 2008 10:09 am

IRTH wrote:
abeg, wetin? u dey get any problems viewing this site? e no dey open for my internet explorer again, na mozilla firefox i come dey use, i no know wht the problem is Sad

I nor dey get problems viewing, e dey open well for my side. Maybe your ISP na dey coz am wey e nor dey open well for your side.
Back to top Go down
View user profile
Wetin?

Posts: 31
Join date: 2008-04-03
Location: Naija

PostSubject: Re: Breaking News!!!   Fri Apr 04, 2008 10:19 am

IRTH wrote:

make we face reality, if not for yahoo, streets for rough now, especially 4 b side. men for go into robbery and all sorts of crimes just to make ends meet, but now as yahoo dey, relative peace done dey the town. even men wey dey do much confra issues those days don cool down dey enter cafe try hustle.....

This na true talk, Guy take a lot of restless jobless youths of the streets. And city like Benin wey nor be industrial city like Lagos, Port Harcourt etc, there is little work for the youths coz the city is mainly run by the Govt and how many people Govt dey employ? If not for Guy, na korokoro day time robbery for dey happen for Benin. Even as Yahoo dey, Omila still dey the town one kind nor to talk now when dem dey burst Guy Men and make dem stop hussle? Na Anini Era dem wan turn Benin into so ooo ...
Back to top Go down
View user profile
Wetin?

Posts: 31
Join date: 2008-04-03
Location: Naija

PostSubject: Re: Breaking News!!!   Fri Apr 04, 2008 10:32 am

And to add to that, Guy reduced other things like trafiking of Benin girls to abroad for prostitution too. I firmly believe so coz then wey Italo dey rain na when Guy never dey but if you take a look at the town right now the thing don reduce well well and not becoz of Eke Igbenedion but becoz of Guy Men.

When Guy Men these days make money though dem dey tuff but dem arrange family too, arrange papa mama and brothas sistas.. those wey be nor dey school will be sent to school and not abroad for prostitution.

Infact the urge of Nigerians running abroad even reduced. These days na holiday boys go dey do abroad not to settle or become illegal immigrants.
Back to top Go down
View user profile
NEVES IRTH
Admin

Posts: 83
Join date: 2008-04-03
Location: G.R.A, B SIDE, NAIJA

PostSubject: Re: Breaking News!!!   Fri Apr 04, 2008 11:50 am

Wetin? wrote:
And to add to that, Guy reduced other things like trafiking of Benin girls to abroad for prostitution too. I firmly believe so coz then wey Italo dey rain na when Guy never dey but if you take a look at the town right now the thing don reduce well well and not becoz of Eke Igbenedion but becoz of Guy Men.

When Guy Men these days make money though dem dey tuff but dem arrange family too, arrange papa mama and brothas sistas.. those wey be nor dey school will be sent to school and not abroad for prostitution.

Infact the urge of Nigerians running abroad even reduced. These days na holiday boys go dey do abroad not to settle or become illegal immigrants.

italo no dey reign again. those days na im be the only way out. one thing way these govt no wan understand be say unlike the politicians wey dey thief money go hide for swiss account, guy men dey circulate the money for naija here, dey help our economy.

_________________
Back to top Go down
View user profile http://naijanomad.darkbb.com
wale

Posts: 19
Join date: 2008-04-04
Location: BENIN CITY, THE HEART BEAT OF NAIJA

PostSubject: Re: Breaking News!!!   Fri Apr 04, 2008 8:05 pm

YES O NOTHING DE HAPPEN, MR KPOLI DON SHOW...LEAVE YAHOO MEN MAKE WE DEY ! ABEG
Back to top Go down
View user profile
 
Breaking News!!!

View previous topic View next topic Back to top 
Page 1 of 2Goto page : 1, 2  Next

Permissions of this forum:You can reply to topics in this forum
NAIJA NOMAD :: GENERAL TALK-
Post new topic   Reply to topic