Interesting but this is what I will call another publicity stunt on the part of Rhymzo.. Truth is Rhymzo don lose e skills thats why e det result to such antics. Even if you slept with her must you make a record about it? Na only e don sleep with the girl before?
If Rhymzo think say na this kind stunt e go take sell records, na bad plan.. Naija nor dey feed on this kind publicity they shy away from it and the artiste goes down and wishes he never did such a thing.. If e wan diss why e nor diss Alex himself? Why drag the wife into it? It is rather foolish if you ask me..
Rhymzo word of advice work on your skills man and make good music, you used to be hot when you released Rock and Roll but what happened? You let it get to your head abi? Arrogance dont sell music in 9ja, humility and skills does. E be like say u nor see wetin happen to Eedris. Where is Eedris today? the boy don humble and the last interview i saw him on TV, Eedris say na only e cause e wan dey fit now and e wan concentrate on his music.. so the boy don learn lesson wey 9ja teach am..
Rhymzo, I see you as the next student of 9ja. 9ja go flog ur yansh well well...lol.. coz e be like say u go be hard learner.